Bismillahi Rahmani Raheem 1. Say: Na im be Allah, na One 2. Allah wey dem dey rest body put 3. E no born pikin, and dem no born Am 4. And nothing dey like Am
Bismillahi Rahmani Raheem 1. Say: I beg for protection from Di Lord of daybreak 2. From di bad tins wey E create 3. And from di bad tins wey dey inside darkness wen day dark. 4. And from di bad of doz wey dey blow breeze inside cloth wey dem tie 5. And from di bad of doz wey dey envy as dem dey envy
Bismillahi Rahmani Raheem 1. Say: I beg for protection from Di Lord of pipu 2. Di King of pipu 3. Di God of pipu 4. From di evil of di whisperer wey dey run hide 5. Wey dey whisper enta pipu mind 6. Among aljannu and among pipu